Skip to content
Thursday 10 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

My wife Bose don join 419

The FrontierThe FrontierFebruary 8, 2025 2623 Minutes read0

Shey una still remember di tori wey I nack una two Saturday ago wey I say “Part-time wife wanted. Apply kia kia!”?

My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2.

But I no know say Bose my wife wey be mother of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don dey do 419 a.k.a Yahoo Yahoo. Di only ting be say Bose 419 no be to take chop money from people, im own 419 na to take am do monitoring spirit.

Make I talk true, dat part-time wife vacancy advert hit gan. If I tell una di number of sisi dem wey call me for my torchlight chinko phone dat very day, hmmm, you no go believe.

Dat day, my phone jus dey ring ti-ti-ti-ti sote my battery peme. And na so I jus dey charge am for inside my guonguoro charger as I dey drive passenger dem for road.

Di ting be say, I come stop to carry passenger wen 12 o’clock pm in di afternoon nack. I go pay for one short-time for Agege. Wen any sisi call me, I go give am di address make e come meet me for screening.

Na so Lagos sisi dem jus dey come, and na so I dey screen dem one by one.

Before one hour pass, I don screen like 20 sisi dem. Tori Olorun!

Na only one sisi I allow to come inside di room at a time. Orders go wait outside till I finish with one.

Na only to screen with my eye I do o. If I do any order ting join am for inside dat short-time room, make I baf naked for bafroom.

During di screening, I come jam one sisi among dem wey get everyting I wan for im body as my part-time wife. Im name na Kemi.

Kemi pass all di test wey I been list out for di vacancy advert dat day:

•Sisi wey no pass 25

•Di two apple for im chest must to stand paparapa like Standard Bank.

•Im Boys quarter must shoot out for angle 360 degree

•No be short and no be tall

•Must sabi deal with alagba like me for bed well well.

Quick, quick, I give Kemi our house address for Abule Egba. I tell am make e resume work as my part-time wife di next morning wey be Sunday. I don plan am say I no go work dat Sunday, I go dey for house to welcome Kemi my part-time wife for one month before Bose come back from Ondo wey e say e go attend im sister pikin graduation, den from dia, e go stay with im alagba Mama for one month.

Dat Saturday evening, I branch Madam Shine buka to go take My Usual and celebrate my part-time wife wey go resume in di morning.

My mind sweet gan. I jus dey tink make night come and make day break quick quick.

As I drive go reach house dat night, I park my guonguoro, carry my bag to enter house…

Na so my wife Bose jus come open di front door for me. I nearly faint. Olorun Oba o!

I ask Bose weda e no travel go Ondo again?

Na so my wife tell me say e no go anywia, say e jus wan try me. I shock! I no fit move one step for wia I tanda.

Shey dat one no be 419?

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

 

Tags
419joinMy wife BoseOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post American model debunks dating rumours with Nigeria’s afrobeats star Asake
next post Chelsea crash out of FA Cup at Brighton
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Why my mother never saw me perform on stage before her death – Music star Mr. Eazi

September 5, 20260
Gists

BBNaija star Tacha breaks silence after arrest over alleged N5 million fraud

September 5, 20260
Matilda Showbiz

I don tire, I dey go back to my village

September 5, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Education

Badejo appointed new LASU Vice Chancellor

September 10, 20260
Health

RED ALERT: Lagos records six confirmed Diphtheria cases •We are taking precautionary measures — Govt

September 10, 20260
Sports

Champions League: PSG thrash Slovan as Barcelona, Liverpool, Arsenal secure opening wins

September 10, 20260
Crime

Abuja woman in Police net for allegedly pouring hot water on neighbour

September 9, 20260
Health

Diphtheria outbreak: Death toll rises to 27 as suspected cases hit 303 in Plateau

September 9, 20260
International

Crude oil surpasses $100 as US-Iran war escalates

September 9, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Badejo appointed new LASU Vice Chancellor

September 10, 2026

RED ALERT: Lagos records six confirmed Diphtheria cases •We are taking precautionary measures — Govt

September 10, 2026

Champions League: PSG thrash Slovan as Barcelona, Liverpool, Arsenal secure opening wins

September 10, 2026

Abuja woman in Police net for allegedly pouring hot water on neighbour

September 9, 2026

Diphtheria outbreak: Death toll rises to 27 as suspected cases hit 303 in Plateau

September 9, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Badejo appointed new LASU Vice Chancellor

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Sharia police arrests married woman in hotel raid in Kebbi

May 15, 2026
3

Summer 2025 UK’s warmest on record — Weather agency

September 1, 2025
4

PDP moves BoT meeting to new venue after police siege

June 30, 2025
5

National Judicial Council recommends Justice Oyewole for appointment to Supreme Court

January 15, 2026
6

Akwa Ibom govt debunks employment alert

February 1, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

JUST IN: Meningitis outbreak kills 26 – Govt

March 11, 2025
3

Group condemns flogging of 3-year-old pupil in Enugu, seeks stricter regulation of private schools

October 13, 2025
4

Opposition: They may soon put all of us in jail — Former Vice President Atiku Abubakar

January 31, 2025
5

Tinubu’s N15.8 trillion reform gains yet to reach Nigerians — Analysts insist

August 23, 2026
6

Passengers feared dead in Niger boat mishap

January 16, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Abuja residents raise alarm over car stands built under high-tension electricity transmission line

August 26, 2025

JUST IN: Governor Eno commissions Bayelsa road, hails Bayelsa counterpart as a daring leader

February 15, 2025

Dangote Refinery gets 4th shipment of crude; 5th coming

January 1, 2024

JUST IN: APC releases Rivers congresses timetable •Pegs chairmanship form at N3 million

October 4, 2024
Top posts

Categories

  • News5012
  • Politics4676
  • Crime4475
  • International3103
  • Sports2508
  • Business & Economy2307
  • Headlines2240
  • Education1395
  • Matilda Showbiz1007
  • Health899
  • Entertainment832
  • Africa595
  • Religion486
  • Environment376
  • Special278
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today211
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade133
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge2

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact