Skip to content
Saturday 8 November 2025
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

My wife Bose don join 419

The FrontierThe FrontierFebruary 8, 2025 1433 Minutes read0

Shey una still remember di tori wey I nack una two Saturday ago wey I say “Part-time wife wanted. Apply kia kia!”?

My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2.

But I no know say Bose my wife wey be mother of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don dey do 419 a.k.a Yahoo Yahoo. Di only ting be say Bose 419 no be to take chop money from people, im own 419 na to take am do monitoring spirit.

Make I talk true, dat part-time wife vacancy advert hit gan. If I tell una di number of sisi dem wey call me for my torchlight chinko phone dat very day, hmmm, you no go believe.

Dat day, my phone jus dey ring ti-ti-ti-ti sote my battery peme. And na so I jus dey charge am for inside my guonguoro charger as I dey drive passenger dem for road.

Di ting be say, I come stop to carry passenger wen 12 o’clock pm in di afternoon nack. I go pay for one short-time for Agege. Wen any sisi call me, I go give am di address make e come meet me for screening.

Na so Lagos sisi dem jus dey come, and na so I dey screen dem one by one.

Before one hour pass, I don screen like 20 sisi dem. Tori Olorun!

Na only one sisi I allow to come inside di room at a time. Orders go wait outside till I finish with one.

Na only to screen with my eye I do o. If I do any order ting join am for inside dat short-time room, make I baf naked for bafroom.

During di screening, I come jam one sisi among dem wey get everyting I wan for im body as my part-time wife. Im name na Kemi.

Kemi pass all di test wey I been list out for di vacancy advert dat day:

•Sisi wey no pass 25

•Di two apple for im chest must to stand paparapa like Standard Bank.

•Im Boys quarter must shoot out for angle 360 degree

•No be short and no be tall

•Must sabi deal with alagba like me for bed well well.

Quick, quick, I give Kemi our house address for Abule Egba. I tell am make e resume work as my part-time wife di next morning wey be Sunday. I don plan am say I no go work dat Sunday, I go dey for house to welcome Kemi my part-time wife for one month before Bose come back from Ondo wey e say e go attend im sister pikin graduation, den from dia, e go stay with im alagba Mama for one month.

Dat Saturday evening, I branch Madam Shine buka to go take My Usual and celebrate my part-time wife wey go resume in di morning.

My mind sweet gan. I jus dey tink make night come and make day break quick quick.

As I drive go reach house dat night, I park my guonguoro, carry my bag to enter house…

Na so my wife Bose jus come open di front door for me. I nearly faint. Olorun Oba o!

I ask Bose weda e no travel go Ondo again?

Na so my wife tell me say e no go anywia, say e jus wan try me. I shock! I no fit move one step for wia I tanda.

Shey dat one no be 419?

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

 

Tags
419joinMy wife BoseOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post American model debunks dating rumours with Nigeria’s afrobeats star Asake
next post Chelsea crash out of FA Cup at Brighton
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Burna Boy becomes first Nigerian musician with 5 Grammy album nominations

November 8, 20250
Gists

Controversial singer, Portable set to go back to school •VIDEO

November 8, 20250
Gists

Media personality, Toke Makinwa dedicates daughter, celebrates birthday in star-studded events

November 8, 20250
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Gists

Burna Boy becomes first Nigerian musician with 5 Grammy album nominations

November 8, 20250
Gists

Controversial singer, Portable set to go back to school •VIDEO

November 8, 20250
Gists

Media personality, Toke Makinwa dedicates daughter, celebrates birthday in star-studded events

November 8, 20250
Gists

Guaranty Trust unveils 8th edition of Fashion Weekend in Lagos

November 8, 20250
Matilda Showbiz

Hot Lyrics: BIG TIME, By Odumodublvck ft. Wizkid

November 8, 20250
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 45

November 8, 20250
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Burna Boy becomes first Nigerian musician with 5 Grammy album nominations

November 8, 2025

Controversial singer, Portable set to go back to school •VIDEO

November 8, 2025

Media personality, Toke Makinwa dedicates daughter, celebrates birthday in star-studded events

November 8, 2025

Guaranty Trust unveils 8th edition of Fashion Weekend in Lagos

November 8, 2025

Hot Lyrics: BIG TIME, By Odumodublvck ft. Wizkid

November 8, 2025

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Burna Boy becomes first Nigerian musician with 5 Grammy album nominations

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

CSOs demand transparent Senate screening of INEC chairman nominee Amupitan

October 10, 2025
3

Messi named Most Valuable Player after record-setting season

December 6, 2024
4

JUST IN: FG declares Tuesday Public Holiday

September 28, 2024
5

Top govt official arrested over 400 sextapes with wives, sisters of important personalities

November 4, 2024
6

Naira abuse: Activists fault Bobrisky’s 6 months jail term

April 12, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Disinformation played significant role in Nigerian civil war – Former President Obasanjo

June 4, 2025
3

Salah strike hands Liverpool draw at Arsenal

October 28, 2024
4

2 pulled from Indonesia school building collapse as rescuers race against time

October 1, 2025
5

World Cup qualifier: Nigeria vs Benin – Date, time, where to watch

October 11, 2025
6

WHO slashes management team after US funding cuts

May 15, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Japa Syndrome: Resident doctors warn of worsening exodus

September 24, 2025

Court orders forfeiture of Keystone Bank N6.3 billion shares to FG

February 11, 2025

Governor Okpebholo approves 21-year jail term for cultists, sponsors in Edo

January 30, 2025

Why we’re yet to pay June salaries to workers – FG

July 11, 2025
Top posts

Categories

  • News3685
  • Politics3152
  • Crime2998
  • International2089
  • Business & Economy1785
  • Sports1731
  • Headlines1644
  • Education1044
  • Matilda Showbiz698
  • Health628
  • Entertainment562
  • Religion361
  • Africa305
  • Environment271
  • Special232
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Arts & Culture177
  • Info Tech173
  • Interview141
  • Inside Akwa Ibom Today122
  • Opinion116
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade89
  • Advert25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends7
  • Local News4

© 2025 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact