Skip to content
Friday 18 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

My wife Bose don dey play me 419

The FrontierThe FrontierApril 4, 2026 1133 Minutes read0

Shey una still remember di tori wey I nack una di order day wey I say “Part-time wife wanted. Na urgent”?

My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2.

But I no know say Bose my wife wey be mother of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don join 419 a.k.a. Yahoo Yahoo. Di only ting be say Bose 419 no be to take chop money from oyibo, im own 419 na to take am do monitoring spirit everywia I go.

Make I talk true, dat part-time wife vacancy advert hit, no be small. If I tell una di number of sisi dem wey call me for my torchlight chinko phone dat very day gan gan, hmmm, una no go believe.

Dat day, my phone jus dey ring ti-ti-ti-ti sote my battery peme. And na so I jus dey charge am for inside my guonguoro charger as I dey drive passenger dem for road. Tori Olorun!

Di ting be say, I come stop to carry passenger wen 12 o’clock pm in di afternoon nack. I go pay for one short-time for Agege. Wen any sisi call me, I go give am di address make e come meet me for screening for dat place.

Na so Lagos sisi dem jus dey come, and na so I dey screen dem one by one.

Before one hour pass, I don screen like 20 sisi dem. Olorun Oba o!

Na only one sisi I allow to come inside di room at a time. Di order ones go wait outside till I finish with one.

Na only to screen with my eye I do o. If I do any order ting join am for inside dat short-time room, make I baf naked for bafroom.

During di screening, I come jam one sisi among dem wey get everyting I wan for im body as my part-time wife. Im name na Kemi.

Kemi pass all di test wey I been list out for di vacancy advert dat day:

•Sisi wey no pass 25

•Di two apple for im chest must to tanda paparapa like Standard Bank.

•Im Boys quarter must shoot out for angle 360 degree like Israel bomb

•No be short and no be tall

•Must sabi deal gan with alagba like me for bed well well.

Quick, quick, I give Kemi our house address for Abule Egba. I tell am make e resume work as my part-time wife di next morning wey be Sunday. I don plan am say I no go work dat Sunday, I go dey for house to welcome Kemi my part-time wife for one month before Bose come back from Ondo wey e say e go attend im sister pikin graduation, den from dia, e go stay with im alagba Mama for one month.

Dat Saturday evening, I branch Madam Shine buka to go take My Usual and celebrate my part-time wife wey go resume in di morning.

My mind sweet gan. I jus dey tink make night come and make day break quick quick.

As I drive go reach house dat night, I park my guonguoro, carry my bag to enter house…

Na so my wife Bose jus come open di front door for me. I nearly faint. Egba mi o!

I ask Bose weda e no travel go Ondo again?

Na so my wife tell me say e no go anywia, say e jus wan try me. I shock! I no fit move one step for wia I tanda.

Shey dat one no be 419?

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
419My wife BoseOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My husband demands for sex when drunk, beats me blue black when I deny him, throws me out
next post Why many Nigerians don’t believe popular social media influencer, Blessing CEO’s breast cancer claims
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Vacancy: Part-time wife wanted. Na urgent!

September 12, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: A co-landlord confessed to me that he had been sleeping with my wife who had told him I was dead

September 12, 20260
Gists

Sensuous American singer and actress Lady Gaga welcomes first child with fiancé

September 12, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
International

Brother of late Princess Diana makes new explosive claims against King Charles III

September 18, 20260
Crime

Eight suspects docked over disappearance of baby from church premises

September 18, 20260
News

Wear APC cap or face consequences — LG chairman threatens commercial drivers

September 18, 20260
International

Can Nigerians join US, UK armies? •Requirements explained

September 18, 20260
Headlines

EXPOSED: Dying moment of 37 suspected miners in Civil Defence custody arrested after ‘refusing to pay bribe’ — Survivor narrates

September 18, 20260
Politics

Disband INEC now over Appeal Court judgment on Electoral Act, says presidential hopeful Gbenga Hashim

September 18, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Brother of late Princess Diana makes new explosive claims against King Charles III

September 18, 2026

Eight suspects docked over disappearance of baby from church premises

September 18, 2026

Wear APC cap or face consequences — LG chairman threatens commercial drivers

September 18, 2026

Can Nigerians join US, UK armies? •Requirements explained

September 18, 2026

EXPOSED: Dying moment of 37 suspected miners in Civil Defence custody arrested after ‘refusing to pay bribe’ — Survivor narrates

September 18, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Brother of late Princess Diana makes new explosive claims against King Charles III

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

UK aims to transform Alzheimer’s disease diagnosis with blood test trial

September 10, 2025
3

Young man stabs ‘sugar mummy’ to death over N100,000

May 8, 2024
4

Pastor jailed 8 years for raping member’s wife

August 7, 2024
5

Policeman killed my husband over N200 — Bayelsa driver’s widow

July 7, 2024
6

Ahead 2027: Why opposition’s fortunes appear gloomy

April 19, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Tinubu sticking to anti-masses policy – Afenifere

August 5, 2024
3

Davido, Montana, others to headline 2025 Africa Cup of Nations kick-off concert tomorrow

December 19, 2025
4

HORRIFIC: Hollywood actress, Dalyce Curry’s body found burnt in Los Angeles home amid wildfires

January 14, 2025
5

Weather forecast: NiMet predicts dust haze across Nigeria from today to Wednesday

December 30, 2024
6

Oil prices jump after China, US tariff suspension

May 12, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

BREAKING: Gunshots, stampede at Rivers assembly as lawmakers begin governor’s impeachment

October 30, 2023

2024 budget too small to meet Nigeria’s needs — Budget Office

December 7, 2023

Trumpet maestro Nathaniel Bassey christens singer Mercy Chinwo’s baby ‘prophetic child’

December 9, 2023

EXPOSED: Real reason ex-defence minister, Badaru resigned

December 6, 2025
Top posts

Categories

  • News5038
  • Politics4728
  • Crime4522
  • International3130
  • Sports2533
  • Business & Economy2330
  • Headlines2248
  • Education1416
  • Matilda Showbiz1016
  • Health910
  • Entertainment843
  • Africa602
  • Religion488
  • Environment377
  • Special278
  • Info Tech251
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today216
  • Interview192
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade134
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge3

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact