Skip to content
Friday 2 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Shey, Dangote na Fada Xmas?

The FrontierThe FrontierMay 9, 2026 1243 Minutes read0

Everyday, na so Naija people go dey carry Dangote name waka upandan. For beer parlour o, na Dangote. For market o, na Dangote. For motor park, school, church, mosque, even shrine o, na Dangote. Na wetin Dangote do una sef? Tori Olorun!

Yesterday, I open my red eye for one passenger wey come our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di bobo say make I carry am for drop go Costain, wey dey after Ojuelegba. I say no wahala. E say I go drive quick, quick go drop am becos e get one business meeting for one office for dia, I say no troublem.

Di bobo wan open door of my guonguoro enter for front seat, I tell am say no be like dat, say e never talk price.

Di bobo ask me how much make e pay, I tell am my price. Come see as di bobo spark like fire. E begin curse me. E say e no blame me and all di stupid old Lagos taxi driver dem, e say na Dangote wey dey increase petrol price per second, per second, e blame. Di bobo come talk how much e go pay me last.

Na dat time I come show am say, even dough I don dagba, me na original agbero I be. Shey, no be for garage my office dey? I be executive agbero.

I tell di bobo say, make e talk true, weda or wedan’t im be young man. I say make e forgot di age wey e dey use work for dat im yeye office.

I ask am say, if e be young man wey e dey claim, how come all di teeth wey dey im mouth don comot finish? Plus im face wey resemble monkey own.

I say make e stop to dey deceive people, plus including all di yeye Lagos olosho dem, say im be young man. I no know weda im village people use ashewo curse am.

I tell am say to wear jankara jacket and tie enter road every morning no mean say e be young man.

I tell am say me, I gree say I be old man and di whole world sabi my age, plus including Google.

I come give am final warning say make e stop to dey carry Dangote name waka everywia becos of petrol price.

I ask am say gofment wey spend money like rain for dia refinery, wia all di refinery dem dey now?

I remind di bobo say, wen Dangote wan build im refinery, gofment collect money nyafu nyafu for di land, after dem come talk for tv, radio and newspaper say gofment give Dangote free land. Olorun Oba o!

I remind di bobo say, wen Dangote build im refinery finish, e beg gofment make dem dey sell crude oil for am for Naira, gofment no gree, dem begin sell crude oil to Dangote for oyibo money.

Sote, gofment come tell di world say dem follow put money for Dangote refinery. I don even forgot who talk am dat time, weda na Lai lai Mohamed sef.

Now, una dey blame Dangote becos e add money for im petrol.

I tell di bobo say make e comot for our garage dey waka for leg go Costain as e no fit pay di taxi money wey I tell am.

I tell am say if e too pain am, make e go meet gofment wey don carry all our refinery wey don peme, dash China people, instead make e dey carry Dangote name dey waka everywia.

I ask am weda Dangote na Fada Xmas wey go dey dash Naija people im petrol free.

If na me be Dangote sef, I know how much I for dey sell my petrol, make all of us continue to suffer am. Mtchewwwwww.

Di ting vex me, no be small.

Dangote na ya mate?

Make we jam again on Saturday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994

Tags
DangoteFada XmasOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Youth Corps members lament as water crisis hits Lagos camp
next post ROMANCE GONE SOUR: After 18 years of marriage, I just found out that my children aren’t mine
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

I don become married bachelor. Tori Olorun!

September 26, 20260
Gists

Africa Magic airs documentary celebrating late veteran actor Olu Jacobs’ legacy

September 26, 20260
Gists

Celebrity boxing against BBNaija star Phyna: Nollywood actress Nkechi Blessing spits fire, brimstone

September 26, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Sports

Team manager Tuchel open to picking players outside Premier League for England

October 2, 20260
Education

University of Ibadan remains Nigeria’s best in new research ranking — Report

October 2, 20260
International

Schools shut as violent protest breaks out in France

October 2, 20260
Crime

Boko Haram terrorists gun down farmers in Borno

October 2, 20260
Arts & Culture

Kano Durbar: Emir Sanusi, Bayero risk arrest for breach of peace

October 2, 20260
News

Edo governor’s aide, social media commentator clash over state govt criticisms

October 2, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Team manager Tuchel open to picking players outside Premier League for England

October 2, 2026

University of Ibadan remains Nigeria’s best in new research ranking — Report

October 2, 2026

Schools shut as violent protest breaks out in France

October 2, 2026

Boko Haram terrorists gun down farmers in Borno

October 2, 2026

Kano Durbar: Emir Sanusi, Bayero risk arrest for breach of peace

October 2, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Team manager Tuchel open to picking players outside Premier League for England

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Customs to install AI-powered scanners at sea ports

April 14, 2026
3

Majestic Arsenal outclass Brighton, return to EPL summit

April 7, 2024
4

UK’s Pound climbs after Labour Party election win

July 5, 2024
5

Liverpool glory would boost Salah’s Ballon d’Or chances – Slot

February 25, 2025
6

One in three Nigerians has hypertension, many unaware — FG

June 23, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

South Africa’s ambassador to France found dead in hotel

September 30, 2025
3

Osun electoral commission presents certificate of return to elected LG chairmen

February 24, 2025
4

Senator Natasha’s return shows we can defeat oppression by standing together – Former Vice President Atiku

September 24, 2025
5

Herbalist nabbed as police recover two murder victims’ corpses

October 27, 2025
6

Man sentenced to life in prison for plotting to kill Trump

February 5, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

National Assembly: Senate throws out controversial 65-yr retirement age bill

February 22, 2024

BREAKING: Meranda missing as impeached Speaker Obasa presides over Lagos Assembly plenary

February 27, 2025

Job racketeering: Police smash syndicate using forged govt documents

November 26, 2024

Fears rise over midnight bomb explosion in Imo

January 13, 2025
Top posts

Categories

  • News5091
  • Politics4797
  • Crime4573
  • International3176
  • Sports2564
  • Business & Economy2355
  • Headlines2264
  • Education1436
  • Matilda Showbiz1032
  • Health923
  • Entertainment867
  • Africa613
  • Religion493
  • Environment392
  • Special279
  • Info Tech258
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today226
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview194
  • Opinion157
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade136
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends24
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact