Skip to content
Thursday 29 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Sikiratu don become emergency star for TikTok

The FrontierThe FrontierJuly 18, 2026 1023 Minutes read0

Wahala no dey finish for dis our Naija. Tell me, how wahala go finish wen be say, everyday, all dis Lagos sisi dem go dey bring out sometin wey dem go take catch man.

Now na for phone e dey happen. Sisi dem go take photo, do video and post for TikTok wey dey inside phone. And di kind photo and video wey dem dey post, hmmm, na di type wey be say, if any bobo see am, e must to swallow saliva. Dem fit use am catch pastor, imam or even babalawo sef.

Me, wetin concern me. Na my taxi driver work I dey face. Wen I comot for our house for Abule Egba for morning, go reach our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, I go park my guonguoro, siddon dey wait for passenger wey I go carry for Drop or for Chatter. Na only call I dey receive with my torchlight chinko phone – no photo, no video. Wetin concern agbero with overload?

SDP Poster Layout

If no be say yesterday as I dey wait for passenger to come, our union member, Akpan, run come show me sometin wey e see for im iPhone.

As Akpan run dey come wia I siddon for di bench wey dey our garage, na so e dey shout, “Oga MAT! Oga MAT!! Come see your babe, e don become star for TikTok o!!!

Na so all our union member dem wey dey for garage dat morning, rush come to look wetin Akpan wan show me.

And true, true, wen we look Akpan phone, come see as Sikiratu dey dance for TikTok video.

No be only dance o, na so Sikiratu dey dance dey bring out tongue like say e wan lick sometin. E go dey shake im nyansh, dey carry leg up make everybody see di dross wey e wear for under di short skirt wey e wear. And na so e go dey shake di two ripe pawpaw wey dey for im chest. Tori Olorun!

As Sikiratu dey dance for di TikTok video, I use style dey look all our union member dia face. Na so all of dem just dey swallow saliva. E be dem like say make dem break Akpan phone, open am and bring out Sikiratu and chop am raw. Olorun Oba o!

Come see as all di bobo dem for di hole world Like, Love and Comment, as Sikiratu dey dance for di video, small remain make e dance naked.

Some of dem comment say, “Sweet Babe, I love you”, “Will you marry me?”, “Where do you live? I want to come and pay your bride price”, “Can I have you my darling in my bed this weekend?”.

I come talk am for my mind say, see dis girl wey dey wash plate and serve customer dem for Madam Shine Buka o. Now, e go tink say all dis bobo dem wey dey comment, love am.

No wonder Sikiratu no dey pick my call again since wen e don dey dance naked for TikTok. E tink say e don become star be dat. E don trowey me for gutter. My Siki Babe?

No troublem. But make Sikiratu make mistake go meet di bobo dem, na dat time e go know say khaki no be leather. E go hear nwi for dia hand. Dem go show am pepper for dia house as dat oga show dat nurse, abi doctor or na fisi…fisio…fisiote…

Abeg make una helep me complete am make I no come bite my tongue.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
emergency starOga MATSikiratuTikTok
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post JUST IN: US places Nigeria, others on highest ‘Do Not Travel’ alert •FULL LIST
next post ROMANCE GONE SOUR: I built my wife a house, spent millions that she could be pregnant only to discover she’s married to someone else
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Politics

2027: ADC Chairman David Mark urges ECOWAS to warn FG, INEC against elections crisis

October 29, 20260
News

Nigerian Army graduates 384 female soldiers in Abuja •PHOTOS

October 29, 20260
Info Tech

Commission targets fake, cloned phones with device checker •How to check status

October 29, 20260
Business & Economy

Nigerian workers challenge Tinubu’s fresh foreign loan request

October 29, 20260
Politics

My administration will reduce number of out-of-school children to zero – SDP presidential candidate Adebayo

October 29, 20260
Politics

BREAKING: Despite court judgment, APC insists Governor Uzodimma is authentic senatorial candidate for Imo West

October 29, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

2027: ADC Chairman David Mark urges ECOWAS to warn FG, INEC against elections crisis

October 29, 2026

Nigerian Army graduates 384 female soldiers in Abuja •PHOTOS

October 29, 2026

Commission targets fake, cloned phones with device checker •How to check status

October 29, 2026

Nigerian workers challenge Tinubu’s fresh foreign loan request

October 29, 2026

My administration will reduce number of out-of-school children to zero – SDP presidential candidate Adebayo

October 29, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

2027: ADC Chairman David Mark urges ECOWAS to warn FG, INEC against elections crisis

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

HURIWA backs Ijaw, Urhobo protest against INEC’s contempt of Supreme Court

August 28, 2025
3

REVEALED: Details about the Army General killed by terrorists in Borno

April 10, 2026
4

Fugitive drug lord wanted in UK and Nigeria for 15 years finally nabbed

March 4, 2026
5

Trump threatens 50 percent tariff on EU from June 1

May 23, 2025
6

Lagos welcomes 5 New Year babies

January 1, 2025
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Again, Tinubu’s soldiers go on rampage, brutalise policeman for alleged wrong parking

January 12, 2024
3

Road to 2027: Tinubu’s likely challengers and political playbooks

August 17, 2025
4

BREAKING: Ohanaeze President General, Iwuanyanwu dead

July 25, 2024
5

Candidates, lecturers call for scrapping of JAMB over 2025 exam issues

May 16, 2025
6

CBN fines UBA, 8 other banks ₦150 million each for ATM cash scarcity •FULL LIST

January 15, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

I feared for my life after police arrested me over WhatsApp post — Varsity lecturer

October 11, 2026

Civil Defence detention deaths: Minister orders probe, state commandant, others suspended

September 18, 2026

Some women accuse men of sexual harassment for personal interest — Woman political activist

March 10, 2025

What to look out for in La Liga this weekend

May 17, 2025
Top posts

Categories

  • News5202
  • Politics4937
  • Crime4675
  • International3266
  • Sports2625
  • Business & Economy2396
  • Headlines2303
  • Education1461
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment898
  • Africa624
  • Religion504
  • Environment408
  • Special279
  • Info Tech271
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion160
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact