Skip to content
Friday 4 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Sikiratu don become emergency star for TikTok

The FrontierThe FrontierJuly 18, 2026 563 Minutes read0

Wahala no dey finish for dis our Naija. Tell me, how wahala go finish wen be say, everyday, all dis Lagos sisi dem go dey bring out sometin wey dem go take catch man.

Now na for phone e dey happen. Sisi dem go take photo, do video and post for TikTok wey dey inside phone. And di kind photo and video wey dem dey post, hmmm, na di type wey be say, if any bobo see am, e must to swallow saliva. Dem fit use am catch pastor, imam or even babalawo sef.

Me, wetin concern me. Na my taxi driver work I dey face. Wen I comot for our house for Abule Egba for morning, go reach our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, I go park my guonguoro, siddon dey wait for passenger wey I go carry for Drop or for Chatter. Na only call I dey receive with my torchlight chinko phone – no photo, no video. Wetin concern agbero with overload?

If no be say yesterday as I dey wait for passenger to come, our union member, Akpan, run come show me sometin wey e see for im iPhone.

As Akpan run dey come wia I siddon for di bench wey dey our garage, na so e dey shout, “Oga MAT! Oga MAT!! Come see your babe, e don become star for TikTok o!!!

Na so all our union member dem wey dey for garage dat morning, rush come to look wetin Akpan wan show me.

And true, true, wen we look Akpan phone, come see as Sikiratu dey dance for TikTok video.

No be only dance o, na so Sikiratu dey dance dey bring out tongue like say e wan lick sometin. E go dey shake im nyansh, dey carry leg up make everybody see di dross wey e wear for under di short skirt wey e wear. And na so e go dey shake di two ripe pawpaw wey dey for im chest. Tori Olorun!

As Sikiratu dey dance for di TikTok video, I use style dey look all our union member dia face. Na so all of dem just dey swallow saliva. E be dem like say make dem break Akpan phone, open am and bring out Sikiratu and chop am raw. Olorun Oba o!

Come see as all di bobo dem for di hole world Like, Love and Comment, as Sikiratu dey dance for di video, small remain make e dance naked.

Some of dem comment say, “Sweet Babe, I love you”, “Will you marry me?”, “Where do you live? I want to come and pay your bride price”, “Can I have you my darling in my bed this weekend?”.

I come talk am for my mind say, see dis girl wey dey wash plate and serve customer dem for Madam Shine Buka o. Now, e go tink say all dis bobo dem wey dey comment, love am.

No wonder Sikiratu no dey pick my call again since wen e don dey dance naked for TikTok. E tink say e don become star be dat. E don trowey me for gutter. My Siki Babe?

No troublem. But make Sikiratu make mistake go meet di bobo dem, na dat time e go know say khaki no be leather. E go hear nwi for dia hand. Dem go show am pepper for dia house as dat oga show dat nurse, abi doctor or na fisi…fisio…fisiote…

Abeg make una helep me complete am make I no come bite my tongue.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
emergency starOga MATSikiratuTikTok
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post JUST IN: US places Nigeria, others on highest ‘Do Not Travel’ alert •FULL LIST
next post ROMANCE GONE SOUR: I built my wife a house, spent millions that she could be pregnant only to discover she’s married to someone else
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Interview

I’ll live forever through my music — Prolific singer and producer Pheelz

August 29, 20260
Gists

Funke Akindele is kind, generous despite strict nature – Nollywood actress Ronke Oshodi-Oke

August 29, 20260
Gists

BBNaija Season 11: Your peace call not convincing – Nomy tells Tram

August 29, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Inside Akwa Ibom Today

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Gov Eno pleased with work progress in Ibom International Hospital

September 4, 20260
Politics

JUST IN: ADC unveils 28 governorship candidates for 2027 election •FULL LIST

September 4, 20260
News

Social media activist VeryDarkMan apologises to security agencies over controversial speech at NBA conference

September 4, 20260
News

FCT minister Wike’s aide clashes with journalist on live TV programme, says ‘I won’t answer questions from you’

September 4, 20260
Sports

BREAKING: Nigeria’s women basketball squad D’Tigress stumble in World Cup opener, lose 99–81 to South Korea

September 4, 20260
News

Police in search for mothers of abandoned babies in Abuja

September 4, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Gov Eno pleased with work progress in Ibom International Hospital

September 4, 2026

JUST IN: ADC unveils 28 governorship candidates for 2027 election •FULL LIST

September 4, 2026

Social media activist VeryDarkMan apologises to security agencies over controversial speech at NBA conference

September 4, 2026

FCT minister Wike’s aide clashes with journalist on live TV programme, says ‘I won’t answer questions from you’

September 4, 2026

BREAKING: Nigeria’s women basketball squad D’Tigress stumble in World Cup opener, lose 99–81 to South Korea

September 4, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Gov Eno pleased with work progress in Ibom International Hospital

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Despite threat, Reps fail to secure arrest of NIMC boss over snub

April 1, 2025
3

Police foil kidnap attempt on 10 passengers in Katsina, 2 dead

December 26, 2024
4

7 silent killers you’ll find in almost every Lagos neighbourhood

May 30, 2025
5

Missing man’s body found on melting glacier after 28 years

August 7, 2025
6

3 feared killed as gunshots rock Ijaw youths election in Rivers

September 15, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Celebration as Desmond Elliot gifts Lagride cars, empowers 700 widows •PHOTOS

January 22, 2024
3

Another kidnappers’ den demolished in Enugu, property owners warned

October 6, 2024
4

Tinubu warns son, Seyi, against ‘undue access’ to FEC meeting

November 1, 2023
5

Shock as National Population Commission chairman dies eight months after assuming office

August 28, 2026
6

NFF set to hold Annual General Assembly in Asaba

October 3, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Palliatives alone can’t solve escalating hunger – Former Vice President Atiku

July 31, 2024

BREAKING: Retired Police AIG’s wife kidnapped

January 17, 2025

How sickle cell can be avoided – Rotary

July 16, 2024

JUST IN: Nigeria’s first Olympics medalist, Maiyegun, is dead

August 27, 2024
Top posts

Categories

  • News4989
  • Politics4651
  • Crime4458
  • International3086
  • Sports2493
  • Business & Economy2295
  • Headlines2239
  • Education1388
  • Matilda Showbiz999
  • Health890
  • Entertainment827
  • Africa588
  • Religion486
  • Environment375
  • Special277
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today209
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade132
  • World Cup 202695
  • Advert35
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge1

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact