I no know wetin dis our union chairman, Jimoh, tink say im be sef. Imagine di likeness! Kilode? Since wen me and all our union member dem begin use dat our garage wey dey for Ikeja under bridge, long time ago, every time we wan do election, Jimoh go say na im go be chairman. […]

