Skip to content
Monday 5 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I don dey use my guonguoro like danfo for dis new year

The FrontierThe FrontierJanuary 18, 2025 2662 Minutes read0

If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija. I swear!

Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse every minute. Money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass na petrol. To buy petrol now na like gold. Today dem go tell us say petrol price don come down, tomorrow dem go say petrol price don go up again. Petrol and Naira now na Taiwo and Kehinde – twins. Na so di two both of dem jus dey go upandan. Tori Olorun!

And without petrol, na im be say we taxi driver no get work again be dat.

Everyday, na so we go siddon for our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, from morning till night, no passenger go show face. People no get money to enter taxi again. Olorun Oba o!

Na so I siddon yesterday for garage dey tink ti-ti-ti-ti. 12 O’clock pm in di afternoon don nack, no passenger. 1 O’clock, 2 O’clock, di same ting. Kilode?

I talk am for my mind say, if I close for evening begin go our house for Abule Egba, wetin my family go chop? And na weekend we dey so.

Na im I quick, quick use my head do aritmetic. I enter my guonguoro, drive am go di order side of di road wey danfo dem dey load passenger go Maryland. Na so I stop, come out, open all my door down. Agbero dem for di bus stop come dey hail me, “Oga MAT wetin happen for dis new year o! Why you comot for taxi park come join danfo dem for bus stop? Twale Baba!!!”

I ask dem weda dem no see as Naija dey now. I say passenger dem no dey come near our garage again from morning till night. I tell Dem to begin load my guonguoro, di same money wey danfo dey collect go Maryland. I give di four both of dem 1k. Agbero dem head scata patapata.

Before I open eye sef, my guonguoro don full – two passenger for front, five for backseat. Dem even ask me weda make dem put anoder passenger for inside boot.

I don carry my passenger dem dey go be dat.

As we dey go, one passenger drop for Police College, one drop for Ikeja Country Club junction, two drop for Abule bus stop, one drop for Leventis bus stop. And as dem dey drop, na so I dey carry anoder passenger like danfo.

Everybody come down for Maryland. Na so I turn my guonguoro face Ikeja, begin load passenger dem again.

My broda, as I reach our garage, my pocket don full. I jus use style dey go Madam Shine buka to take My Usual before I begin go house.

Man pikin no go come peme for Naija for dis new year.

Helep me say Amin!

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
danfoguonguoroNew YearOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: PIECE OF MY HEART, by Wizkid ft Brent Faiyaz
next post Timaya’s relationship with Black American TV star Brooke Bailey hots up
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Life beyond cameras: Yusuf, Bells and Chimsom reflect on growth, truth and survival in the BBNaija house

October 3, 20260
Gists

How we went into trance while filming — Actress Yetunde Barnabas

October 3, 20260
Gists

Meet Top 10 richest women in the world

October 3, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Crime

[JUST IN] NYSC kidnap: Kidnappers slash ransom to N100 million as public outrage mounts

October 5, 20260
Politics

INEC to brief Nigerians as 2027 elections enter 100-day countdown

October 5, 20260
Education

Varsity withdraws 56 students, expels one for exam malpractice

October 5, 20260
Business & Economy

Gas commercialisation falters as 22 of 42 awardees struggle to develop flare sites

October 5, 20260
Crime

How Nigerians are crowdfunding ransom for kidnapped prospective NYSC members

October 5, 20260
Entertainment

Temi Nkem: 10 things to know about BBNaija Season 11 winner

October 5, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

[JUST IN] NYSC kidnap: Kidnappers slash ransom to N100 million as public outrage mounts

October 5, 2026

INEC to brief Nigerians as 2027 elections enter 100-day countdown

October 5, 2026

Varsity withdraws 56 students, expels one for exam malpractice

October 5, 2026

Gas commercialisation falters as 22 of 42 awardees struggle to develop flare sites

October 5, 2026

How Nigerians are crowdfunding ransom for kidnapped prospective NYSC members

October 5, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

[JUST IN] NYSC kidnap: Kidnappers slash ransom to N100 million as public outrage mounts

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Awujale throne: KWAM 1 not our family member – Ruling house disowns Fuji musician

December 11, 2025
3

2027: Talks ongoing for Peter Obi, Jonathan to join PDP presidential race — Senator Moro

August 27, 2025
4

Ahmadu Bello University to host 29th NUGA games

January 9, 2026
5

Appeal Court nullifies judgment on Rivers LG election

November 22, 2024
6

Various governments scramble to evacuate citizens from Israel, Iran •FULL LIST

June 19, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

TRAGEDY: Tipper crushes 2 varsity students to death

August 14, 2025
3

Super Falcons goalkeeper Nnadozie signs for Brighton & Hove Albion

June 28, 2025
4

WHO warns Nigeria among nations falling short of 2025 End TB targets

January 7, 2026
5

8-month pregnant housewife files for divorce

June 5, 2026
6

Let Senate kill all of us if it wants, we’ll stand by Natasha, says activist Aisha Yesufu

July 21, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Beyond bullets, negotiations and ransom: Yorubaland in the grip of terrorists

June 19, 2026

Protests: Judiciary complicit in oppression, suppression of Nigerians – Activist Farotimi

September 27, 2024

Oil workers strike will not cause fuel shortage — Dangote Refinery assures Nigerians

September 9, 2025

JUST IN: 2 petrol tankers explode at filling station

February 5, 2025
Top posts

Categories

  • News5096
  • Politics4804
  • Crime4580
  • International3181
  • Sports2566
  • Business & Economy2357
  • Headlines2265
  • Education1437
  • Matilda Showbiz1040
  • Health925
  • Entertainment871
  • Africa613
  • Religion493
  • Environment394
  • Special279
  • Info Tech258
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today226
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview195
  • Opinion158
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade136
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact