Skip to content
Monday 7 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Lagos sisi dem don bring anoder banger

The FrontierThe FrontierJuly 12, 2025 1931 Minutes read0

I jus dey pray say make Eledumare get pity for us man pikin dem wey dey for Lagos.

Di kind orisirisi trap wey Lagos sisi dem dey set for man pikin, e too much.

If dem try one ting and e come be like say people don come sabi dat ting, dem go change am, try anoder system.

E come be like say na only how to set trap to take tear man dia pocket patapata na im all dis Lagos sisi dem dey siddon dey plan everyday. Tori Olorun!

Na so I siddon yesterday for our garage wey dey near under Ikeja bridge, two sisi waka come. Dem tell me make I carry dem go Balogun market. I say oya nah. Dem say dem dey go do shopping, weda I go wait, after dem don buy wetin dem wan buy finish, I go carry dem come back for Anifowoshe for Ikeja.

I tell dem say to carry dem go Balogun market for Isale Eko, dat one na drop, e get im own price. But to wait for dem and bring dem back to Ikeja, dat one na charter. Dem ask me di price of di two both of dem, I tell dem. Dem say make I carry dem for charter. Quick, quick di yellow sisi comot money for purse, pay me complete. Olorun Oba o!

Wetin I dey wait for? No be money I find come for Lagos?

I open my guonguoro door kia kia, di two both of dem siddon for backseat. I close di door, salute dem, den run go open my own door and jump inside for steering. I open ignition, start di engine, put am for gear one, and off we go.

We no even reach Ikeja Roundabout wen dis two sisi dem begin nack tori.

And wetin dem dey talk, all na about how dem dey set trap for man to drop pay.

(To be continued)

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
anoder bangerLagosOga MATsisi dem
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: TATATA, by Burna Boy ft. Travis Scott
next post ROMANCE GONE SOUR: I developed high blood pressure after I discovered my husband had another wife
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Why my mother never saw me perform on stage before her death – Music star Mr. Eazi

September 5, 20260
Gists

BBNaija star Tacha breaks silence after arrest over alleged N5 million fraud

September 5, 20260
Matilda Showbiz

I don tire, I dey go back to my village

September 5, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
News

Break your silence on Tinubu’s US probe — Yoruba Ronu tells Obasanjo, other elder statesmen •US advocate drags Nigerian senior govt officials

September 7, 20260
Health

Lassa fever, cholera, diphtheria emergencies expose gaps in Nigeria’s health system

September 7, 20260
News

Governor Adeleke embarks on vacation to UK, probes Obaship dispute

September 7, 20260
Crime

TRAGEDY: Gunmen kill National Open University of Nigeria Bursar

September 7, 20260
Africa

Nigeria facilitates return of former Sierra Leone President Koroma

September 7, 20260
Sports

Harvertz stars as Arsenal overpower Chelsea to maintain perfect League start

September 7, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Break your silence on Tinubu’s US probe — Yoruba Ronu tells Obasanjo, other elder statesmen •US advocate drags Nigerian senior govt officials

September 7, 2026

Lassa fever, cholera, diphtheria emergencies expose gaps in Nigeria’s health system

September 7, 2026

Governor Adeleke embarks on vacation to UK, probes Obaship dispute

September 7, 2026

TRAGEDY: Gunmen kill National Open University of Nigeria Bursar

September 7, 2026

Nigeria facilitates return of former Sierra Leone President Koroma

September 7, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Break your silence on Tinubu’s US probe — Yoruba Ronu tells Obasanjo, other elder statesmen •US advocate drags Nigerian senior govt officials

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

I don’t see cause for celebration over end of emergency rule in Rivers — Senior lawyer Adegboruwa

September 18, 2025
3

Trump to hold first outdoor rally since assassination attempt

August 21, 2024
4

Xenophobia: Nigeria won’t accept any humiliation or damage to its interests, says Tinubu’s aide

July 1, 2026
5

Minister test runs e-gates at airports

April 19, 2024
6

Salah told to leave as Trent Alexander-Arnold admits transfer regret

February 23, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Wizkid, Davido, Olamide perform as Detty December begins in Lagos

December 17, 2025
3

Japa: Resist temptation to abandon Nigeria – Former Minister Fashola tells youths

November 10, 2024
4

Gov Zulum approves N55.9million for 153 medical students

January 6, 2024
5

Lagos govt, marketers’ dispute threatens fuel distribution nationwide

June 18, 2025
6

Expatriate quota: FG announces date to begin clampdown on irregular migrants

March 26, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

EyeCare with Dr Priscilia Imade: How to love your eyes

October 21, 2024

Like Ghana, opposition will triumph over APC in 2027 — PDP

December 9, 2024

Oil-starved Cuba confirms talks with US

March 13, 2026

Peter Obi slams Tinubu over hunger, insecurity, economic hardship

May 27, 2026
Top posts

Categories

  • News4996
  • Politics4657
  • Crime4463
  • International3091
  • Sports2499
  • Business & Economy2297
  • Headlines2239
  • Education1389
  • Matilda Showbiz1007
  • Health891
  • Entertainment828
  • Africa591
  • Religion486
  • Environment375
  • Special278
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today210
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade133
  • World Cup 202695
  • Advert35
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge1

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact