Skip to content
Tuesday 8 July 2025
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

No be only Prophet, na Alfa

The FrontierThe FrontierMarch 23, 2024 1633 Minutes read0

*Replay

Di kind tings wey dey shele for dis Lagos now, I confuse.

Man pikin go comot for house for early morning before everybody wake up, I go put my guonguoro for road, to go find wetin I go take give my family food, na so rat go come wake cat wey dey sleep up.

Di order day, one passenger like dat come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say make I go drop am for Isale Eko. I ask am wia gan gan for Isale Eko, e say Idumota market.

I look time, 2 O’clock pm in di afternoon don nack. I talk am for my mind say time still dey, patapata I use one hour go drop am and begin come back to Ikeja. But my broda, e no come be as I tink.

I comot for Idumota by 4 O’clock pm in di evening as I drop di passenger finish. I take IBB Bridge to begin come back, hmmm, I never see di kind Go-slow wey dey dat evening since I begin do dis my taxi driver work for Lagos. I hear nwi dat day. I dey inside Go-slow for 5 hours. Tori Olorun!

I look time wen I reach Alausa, I see say time don go well well, na im I begin drive dey go our house wey dey for Abule Egba.

As I reach house, I never come down from my guonguoro wen my second woman pikin, Funke, run come meet me, e say im sister dey cry since afternoon. Ehn? My first woman pikin, Bisi, dey cry since afternoon? Wetin happen?

I no even remember weda or wedan’t I close di door of my guonguoro as I jump out and begin run enter house dat night.

True true, I see Bisi siddon for chair for parlour dey cry. I ask am wetin happen. I ask am who give am belle? I nearly give am dirty slap sef. Na dat time im Mama, my wife Bose, tell me say no be belle, say na our landlord, Baba Braimoh man pikin, be wahala.

Bose come talk say, as Braimoh come visit im Papa and Mama dat afternoon, e come our room and parlour to greet us, but na only Bisi dey for house dat time.

E say as Braimoh jus see Bisi, e say shiooor, na dis girl don grow like dis? Di next ting be say, e begin touch Bisi pawpaw for chest and nyansh, carry Bisi dress up and try to put im finger for my pikin kini. Wen Bisi no gree, e slap Bisi for eye pppuuuooorrr! Na so Bisi eye swell up. And Bisi begin shout, cry and people come full di compound. E say dem jus dey come back from hospital. Olorun Oba o!

See Braimoh wey talk say e don stop to dey smoke wee wee o, say now e be prophet for one church like dat for Mushin o! Na dis fake prophet wan rape my pikin for inside my house o! See me, see troublem o!

Na im I march go Baba Braimoh room go begin knock im door po, po, po! Di old man open door, begin shout for my head say why I hit im door like dat dis night. I tell am say I dey find Braimoh. E ask me why I dey find im pikin. I ask am weda dat one na JAMB question? I ask am weda e no hear wetin Braimoh do my first woman pikin Bisi?

Baba Braimoh ask me wetin be dat, na im I call Bisi make e come tell Baba Braimoh wetin im pikin do.

Wen Bisi talk finish, Baba Braimoh hiss, den ask weda me and my pikin get any evidence or proof of say Braimoh wey be prophet do am dat kind ting. Ewo!

I tell am say prophet ko, Alfa ni. I ask am weda im wee wee son own na prophet for woman nyansh.

Na di matter of proof we still dey till today.

No worry, I go nack una di tori of how we waka anoda day.

Make we jam again on Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.

 

 

Tags
AlfaOga MATprophet
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM
next post ROMANCE GONE SOUR: My husband appeared gentle while we dated via Facebook, but I later realised he’s a brute
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: Although he has divorced me, I will not move out of my husband’s house

June 28, 20250
Gossips

“Who Wants To Be A Millionaire” anchorman, Frank Edoho’s second marriage crashes

June 28, 20250
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 26

June 28, 20250
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Politics

Coalition: 97 lawyers line up to defend ADC, Mark, Aregbesola against APC’s ‘fake lawsuit’

July 8, 20250
Crime

EFCC probes man nabbed with undeclared $420,900 at Kano airport

July 8, 20250
Politics

Make my father’s murderers uncomfortable – Late former justice minister Bola Ige’s son tells Tinubu

July 8, 20250
Politics

ADC decries Nigeria’s exclusion from Donald Trump’s meeting with 5 other African presidents

July 8, 20250
News

Businesses collapsing, kids out of school – Anglican Church tells Tinubu

July 8, 20250
International

US to send more weapons to Ukraine — Donald Trump

July 8, 20250
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Coalition: 97 lawyers line up to defend ADC, Mark, Aregbesola against APC’s ‘fake lawsuit’

July 8, 2025

EFCC probes man nabbed with undeclared $420,900 at Kano airport

July 8, 2025

Make my father’s murderers uncomfortable – Late former justice minister Bola Ige’s son tells Tinubu

July 8, 2025

ADC decries Nigeria’s exclusion from Donald Trump’s meeting with 5 other African presidents

July 8, 2025

Businesses collapsing, kids out of school – Anglican Church tells Tinubu

July 8, 2025

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Coalition: 97 lawyers line up to defend ADC, Mark, Aregbesola against APC’s ‘fake lawsuit’

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Governor Abiodun approves promotion of over 26,000 Ogun State workers

January 10, 2025
3

EyeCare with Dr Priscilia Imade: Lifestyle and eye-health

December 11, 2023
4

US Supreme Court agrees to hear TikTok ban case

December 19, 2024
5

Crisis hits NMA as 2 factional chairmen emerge

August 12, 2024
6

2025 will sweep away years of hardship — Former Vice President Atiku

December 31, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Mining areas record rise in out-of-school children —Report

May 4, 2024
3

INSIDE AKWA IBOM TODAY: APC chairman commends Governor Eno as performing leader

March 24, 2025
4

Boko Haram terrorists burn down church, kill 2 in Borno

January 13, 2025
5

JAMB announces fresh mop-up exam for 2025 UTME absentees

May 21, 2025
6

My eyes are on your body – Controversial street musician Portable tells actress Regina Daniels

April 5, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Hojlund ends goal drought in Man United’s epic comeback against Villa

December 27, 2023

Facing uncertain future: Lagos market fire victims count losses in hard times

April 13, 2024

Varsity expels 175 students

July 9, 2024

Football star Marc Guehi writes ‘Jesus Loves You’ on rainbow armband, defying Premier League guidelines

December 4, 2024
Top posts

Categories

  • News2987
  • Crime2558
  • Politics2441
  • International1671
  • Business & Economy1567
  • Headlines1405
  • Sports1401
  • Education854
  • Matilda Showbiz574
  • Health501
  • Entertainment424
  • Religion319
  • Environment236
  • Hunger protests in Nigeria223
  • Special212
  • Africa200
  • Info Tech153
  • Arts & Culture145
  • Interview113
  • Opinion86
  • Inside Akwa Ibom Today82
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade73
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Advert17
  • Trends5
  • Local News4

© 2025 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact