Replay…from last edition
As I go drop one passenger like dat for Satellite Town di order day, night don show face. Na im make as I dey come back, I no branch our garage wey dey near Ikeja under bridge. I no even fit go take My Usual for Madam Shine buka. I jus drive stret to house for Abule Egba.
As I wan enter bed, my wife Bose tell me say rice wey dey for house don finish, and na weekend we dey so.
I no even comot for bed for morning wey Bose remind me say rice don finish for house. I tell am say I don hear.
As I wash my guonguoro finish dat morning, I carry 10 litre keg wey I go use buy petrol bring come house for generator. My broda, heat nearly kill us for night as e be say now na only blackout NEPA dey generate, no light.
I drive comot for our street to enter dat Abule Egba Expressway, I see say di fuel level for my guonguoro don show red. I kukuma branch one petrol station for dat road. Di petrol station sisi ask me how much petrol I wan buy, weda na fill up. I tell am how much I wan buy. I talk am for my mind say fill up ko, fill down ni. Who dey fill up for dis Emilokan time? I also buy for di keg wey I carry from house make I no come forgot.
I no even reach di next bus stop wey one bobo like dat stop me. E say make I go drop am for Onyigbo. I tell am my price, e gree. I say make e enter.
Na so I begin fire my guonguoro dey go. I take Oworonsoki, to take IBB Bridge, den come down for Ebute Meta.
As we jus climb IBB small, na so my guonguoro jus quench patapata. I see say my petrol don show red again, on top of bridge o.Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Saturday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.