Skip to content
Tuesday 20 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Shey, Dangote na Fada Xmas?

The FrontierThe FrontierMay 16, 2026 1943 Minutes read0

Replay 

Everyday, na so Naija people go dey carry Dangote name waka upandan. For beer parlour o, na Dangote. For market o, na Dangote. For motor park, school, church, mosque, even shrine o, na Dangote. Na wetin Dangote do una sef? Tori Olorun!

Yesterday, I open my red eye for one passenger wey come our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di bobo say make I carry am for drop go Costain, wey dey after Ojuelegba. I say no wahala. E say I go drive quick, quick go drop am becos e get one business meeting for one office for dia, I say no troublem.

SDP Poster Layout

Di bobo wan open door of my guonguoro enter for front seat, I tell am say no be like dat, say e never talk price.

Di bobo ask me how much make e pay, I tell am my price. Come see as di bobo spark like fire. E begin curse me. E say e no blame me and all di stupid old Lagos taxi driver dem, e say na Dangote wey dey increase petrol price per second, per second, e blame. Di bobo come talk how much e go pay me last.

Na dat time I come show am say, even dough I don dagba, me na original agbero I be. Shey, no be for garage my office dey? I be executive agbero.

I tell di bobo say, make e talk true, weda or wedan’t im be young man. I say make e forgot di age wey e dey use work for dat im yeye office.

I ask am say, if e be young man wey e dey claim, how come all di teeth wey dey im mouth don comot finish? Plus im face wey resemble monkey own.

I say make e stop to dey deceive people, plus including all di yeye Lagos olosho dem, say im be young man. I no know weda im village people use ashewo curse am.

I tell am say to wear jankara jacket and tie enter road every morning no mean say e be young man.

I tell am say me, I gree say I be old man and di whole world sabi my age, plus including Google.

I come give am final warning say make e stop to dey carry Dangote name waka everywia becos of petrol price.

I ask am say gofment wey spend money like rain for dia refinery, wia all di refinery dem dey now?

I remind di bobo say, wen Dangote wan build im refinery, gofment collect money nyafu nyafu for di land, after dem come talk for tv, radio and newspaper say gofment give Dangote free land. Olorun Oba o!

I remind di bobo say, wen Dangote build im refinery finish, e beg gofment make dem dey sell crude oil for am for Naira, gofment no gree, dem begin sell crude oil to Dangote for oyibo money.

Sote, gofment come tell di world say dem follow put money for Dangote refinery. I don even forgot who talk am dat time, weda na lai lai Mohamed sef.

Now, una dey blame Dangote becos e add money for im petrol.

I tell di bobo say make e comot for our garage dey waka for leg go Costain as e no fit pay di taxi money wey I tell am.

I tell am say if e too pain am, make e go meet gofment wey don carry all our refinery wey don peme, dash China people, instead make e dey carry Dangote name dey waka everywia.

I ask am weda Dangote na Fada Xmas wey go dey dash Naija people im petrol free.

If na me be Dangote sef, I know how much I for dey sell my petrol, make all of us continue to suffer am. Mtchewwwwww.

Di ting vex me, no be small. Dangote na ya mate?

Make we jam again on Saturday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994

Tags
DangoteFada XmasOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 20
next post ROMANCE GONE SOUR: I developed high blood pressure after I discovered my husband had another wife
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Two movie roles that pushed me out of my comfort zone — Actress Etinosa

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Neto double gives Chelsea win over Everton; marred by Martinez injury

October 17, 20260
Gists

Walk away if marriage isn’t working — Nollywood actress Uche Ogbodo

October 17, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Politics

2027: SDP to scrap bulletproof SUVs, charter jets for govt officials – Presidential candidate Adebayo

October 20, 20260
Headlines

JUST IN: Police disperse Lekki tollgate #EndSARS memorial with teargas

October 20, 20260
Crime

20 NYSC members kidnap: DSS arraigns 5 suspects in Imo •PHOTO

October 20, 20260
Business & Economy

Fuel subsidy removal: Moses can’t go back to Egypt, says Tinubu

October 20, 20260
Business & Economy

Former Vice President Atiku blasts Tinubu over hardship, fuel subsidy; says “You are the Egypt Nigerians are desperate to escape”

October 20, 20260
News

Defunct Nigeria Airways: Fresh N4 billion released for 600 former employees

October 20, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

2027: SDP to scrap bulletproof SUVs, charter jets for govt officials – Presidential candidate Adebayo

October 20, 2026

JUST IN: Police disperse Lekki tollgate #EndSARS memorial with teargas

October 20, 2026

20 NYSC members kidnap: DSS arraigns 5 suspects in Imo •PHOTO

October 20, 2026

Fuel subsidy removal: Moses can’t go back to Egypt, says Tinubu

October 20, 2026

Former Vice President Atiku blasts Tinubu over hardship, fuel subsidy; says “You are the Egypt Nigerians are desperate to escape”

October 20, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

2027: SDP to scrap bulletproof SUVs, charter jets for govt officials – Presidential candidate Adebayo

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

BBNAIJA 10: Six new housemates join nine others

July 27, 2025
3

BREAKING: Police summons Organised Labour leader, Joe Ajaero over terrorism charges, others •Threatens arrest

August 19, 2024
4

Lagos announces deadline for registration of UBE placement test

April 8, 2025
5

Travels: Presidency spends N34 billion on foreign exchange in two years

February 2, 2026
6

Tinubu jets out to Tanzania for Heads of State Energy Summit

January 26, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Alleged defamation: Dele Farotimi released after meeting bail conditions

December 24, 2024
3

1 burnt to death, 3 injured in Lagos multiple gas trucks explosion

February 8, 2024
4

Employers reject FG’s pension contribution hike

July 24, 2026
5

NLC sacks Police, Edo govt from premises

December 20, 2024
6

ROMANCE GONE SOUR: My husband accused me of infidelity, dared me to cross charm he placed on the floor

December 13, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Despite court order, EFCC fails to produce Emefiele

November 6, 2023

How suspected robber raped my wife, threatened my family – Witness

March 20, 2025

Party crises distracting us, fueling apathy – INEC •Conduct credible elections to restore trust – Parties

March 5, 2026

FG repatriates 390 Nigerian migrants from Niger Republic

January 14, 2025
Top posts

Categories

  • News5164
  • Politics4875
  • Crime4633
  • International3237
  • Sports2601
  • Business & Economy2382
  • Headlines2293
  • Education1451
  • Matilda Showbiz1054
  • Health949
  • Entertainment889
  • Africa618
  • Religion501
  • Environment403
  • Special279
  • Info Tech265
  • Arts & Culture244
  • Inside Akwa Ibom Today235
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview198
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade138
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact