…continued from last Saturday edition As I match break and pack my guonguoro for roadside, I tell di sisi make e come down, I no even remember to tie my shokoto rope back, I open my driver door and come down. I turn go passenger door, I open am, say make di oloshio come down […]
Di kind wahala wey man pikin dey see for dis our taxi driver work everyday, I don dey tink dis new year weda or wedan’t make I stop di work. But di ting be say, if I say make I no do taxi driver work again, na wetin I go come dey do as I […]
Una kukuma remember say, as Keresimesi near last year, na so all dose Lagos sisi dem dey come dey rush me make I do Keresimesi for dem. I talk am for my mind say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimesi? My broda, na so I took off o, I no show face again […]
Dear Oga Patapata, I dey vex for you well well, but before I start dis my letter to you, make I still manage to say Happy Keresimesi and Mary (or Remi) New Year wey dey come, to you. Oga Patapata, why I dey vex for you no be becos you allow Oyibo bring jet come […]
Dem dey talk am say body no be wood. And na true talk. You sef check am nah. Everyday di son of man dey for Lagos road 24/7, dey carry passenger dem upadan. And na orisirisi tings I dey see for road – di good, di bad, and di OBJ (sorry, abeg no vex. I […]
Every year by dis time, na so so Lagos sisi dem man pikin go dey see left, right and center. And all of dem wan make you do Keresimasi for dem. Even all dose sisi dem wey no dey greet me for our street for Abule Egba, now if dem see me, dem go first […]
(Continued from last week) As I open di door and follow di two Soja, dem carry me go di two truck wey dem bring come. Dem bring 10 jerry can down. Dem say na petrol and na me get am. Na so dem drive comot, begin dey go. I jus tanda for outside dia, everytin […]
Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat, especially as Keresimesi don dey near so. First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”. Wen you settle dat one, […]
Since two week now, na so, so Trump dey for all Naija people mouth. You go to market, na Trump. Go to church or mosque, na Trump. Go to any school, na Trump. Waka for road or enter taxi, BRT, danfo, Keke Marwa or Okada, na Trump. Di ting come get as e be since […]
…Continued from last week Na im di pelenge man wey our union chairman Jimoh bring come our garage for meeting, talk say report get to am for state chapter say all of us dey plan to overthrow our branch chairman Jimoh. Say na me, Oga MAT, be di chief coup plotter wey dey plan to […]

