Everyday, na so Naija people go dey carry Dangote name waka upandan. For beer parlour o, na Dangote. For market o, na Dangote. For motor park, school, church, mosque, even shrine o, na Dangote. Na wetin Dangote do una sef? Tori Olorun! Yesterday, I open my red eye for one passenger wey come our garage […]
Replay If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija. Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse per second, per second. Money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass now na petrol. To buy petrol now na […]
If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija. Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse per second, per second. Money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass na petrol. To buy petrol now na like gold. […]
Shey una still remember di tori wey I nack una di order day wey I say “Part-time wife wanted. Na urgent”? My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2. But I […]
As tings come dey now, everybody must take im destiny for im own hand, if no be so, person go jus peme for noting. Say Olorunmaje! Now I don decide say, anyting wey happen, instead make I jus siddon dey tink from morning till night, I go find how I go do make dat ting […]
E no good make agbalagba like me wey don marry tipe tipe come begin live alone like bobo wey never marry teletele. Na dat one oyibo dem dey call married bachelor. Abi no be so? My wife Bose travel go dia village for Ondo since last week. E say e wan go see im Mama, […]
Di kind orisirisi tings wey man pikin dey see for dis our taxi driver work, person no fit talk am finish. Di order day, trailer nearly push me, my guonguoro and my passenger inside Lagos Lagoon. Helep me say Olorun maje! Na so I carry one madam like dat for drop go Balogun market. We […]
…Continued from last Saturday episode As my wife Bose, jump comot for bed, go lie down for ground for dat kind cold night, I no come sabi wetin I go do again. And sleep no wan catch me. How sleep go catch me wen my kini still tanda for attention paparapa? Na so I come […]
Di kind cold wey dey since dis week show face, hmm, if all dis sisi and bobo dem no take time, Naija go reach 2 billion people after nine months. No be sisi and bobo dem alone, even husband and wife dem dey inside. Now, to stand up for bed for morning, put my guonguoro […]
Di kind tings wey dey shele for dis Lagos now, I confuse. Man pikin go comot for house for early morning before everybody wake up, I go put my guonguoro for road, to go find wetin I go take give my family food, na so rat go come wake cat wey dey sleep up. Di […]

