Skip to content
Sunday 18 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

My pikin wan marry Oyibo

The FrontierThe FrontierJune 6, 2026 1052 Minutes read0

I dey always talk am say, na Funke tear eye pass di two woman pikin dem wey my wife Bose born for me.

Im senior sister Bisi na gentle pikin but im sister Funke na inwi. Im gragra two much.

Na so Funke begin dey follow one Fulani herdsman like dat wey dey carry cow waka for all di street and bush for our area Abule Egba. Na im senior sister report am to me. Wen I ask Funke wetin im and di Aboki get in comon, e tell me say, “Nothing, he is just a friend, Daddy.”

SDP Poster Layout

A friend with Fulani herdsman? Dis my second woman pikin no go kill me o. Tori Olorun!

We never talk dat one finish, on Monday dis week, Funke say e wan bring man wey e wan marry come show me and im Mama. I ask am weda e don reach to marry wen be say im senior sister dey plan to enter uniservity. Funke tell me say na im sister own be dat, say e ready to marry, and na oyibo e wan marry.

Ehn? Oyibo? For wia my pikin see oyibo wey e wan marry?

But make I no lie, di ting sweet me for mind gan say my pikin wan marry oyibo. I come talk am for my mind say, so, me sef go begin dey count my money in dollar. Olorun Oba o!

I ask Funke which day e wan bring di oyibo come house make we see am. E say Friday (wey be yesterday). I say no troublem, say I go give im Mama money make e use cook better point-and-kill and I go buy correct wine to take welcome our oyibo son in-law.

Yesterday, I no go work, I park my guonguoro for our compound for Abule Egba. I no just reach our garage wey dey near Ikeja Under Bridge. All of us dey wait for oyibo to come.

I look time, 11 O’clock a.m. in di morning don nack. I ask Funke weda im oyibo husband no go come again. Funke tell me say oyibo dey come for road, say e don nearly reach our house sef.

Small time I hear okada sound pruumm, pruumm, pruumm for outside. Funke run come tell me say im oyibo husband-to-be don land. I tell am make e bring am inside quick quick, make e no allow my oyibo son in-law wait for outside for too long.

Wen Funke bring di oyibo inside, my broda, I shock, I nearly faint!

I ask Wasiu wey we dey call oyibo for garage wetin e dey find for my house. Wasiu say na im wan marry my second woman pikin Funke. I ask am, you? E say yes nah.

See me see wahala o. So, my pikin don look all di man dem wey dey for dis world finish, na Wasiu e wan marry. Afin wey im eye be half past four. Afin wey be agbero wey dey load passenger motor for Ipodo, na im my pikin wan marry?

As I rush enter room, before I come out, Afin don disappear. E know wetin I want bring come. I for use matchet cut dat im red head comot dat yesterday. Aswe! Oyibo ko, Oyingbo market ni.

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994

Tags
marry OyiboMy pikinOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 23
next post ROMANCE GONE SOUR: Our last child is not mine, I want divorce
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Two movie roles that pushed me out of my comfort zone — Actress Etinosa

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Neto double gives Chelsea win over Everton; marred by Martinez injury

October 17, 20260
Gists

Walk away if marriage isn’t working — Nollywood actress Uche Ogbodo

October 17, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Crime

Hunters kill kidnappers who came for ₦10 million ransom

October 18, 20260
Crime

Mother sells one-month-old baby for N2 million

October 18, 20260
Health

Why husbands should be in labour rooms with wives — Gynaecologists

October 18, 20260
News

Army chief visits Borno as parents lament children’s 155 days in kidnappers’ den

October 18, 20260
Headlines

REVEALED: How I received threats, my mother kidnapped over $2.4 billion fuel subsidy fraud probe — Ngozi Okonjo-Iweala recounts

October 18, 20260
Politics

EXPOSED: I never purchased nomination form for 2027 governorship election, says purported Ogun PDP aspirant

October 18, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Hunters kill kidnappers who came for ₦10 million ransom

October 18, 2026

Mother sells one-month-old baby for N2 million

October 18, 2026

Why husbands should be in labour rooms with wives — Gynaecologists

October 18, 2026

Army chief visits Borno as parents lament children’s 155 days in kidnappers’ den

October 18, 2026

REVEALED: How I received threats, my mother kidnapped over $2.4 billion fuel subsidy fraud probe — Ngozi Okonjo-Iweala recounts

October 18, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Hunters kill kidnappers who came for ₦10 million ransom

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Air Force announces aptitude test date, centres for recruitment •FULL LIST

December 9, 2024
3

Iran fires missiles at Israel in new escalation

October 2, 2024
4

68 pledges unmet as 10th National Assembly winds up — Report

June 15, 2026
5

Senate reshuffles committee leadership, appoints chairmen for regional development commissions

February 4, 2025
6

Governor Otti orders rehabilitation of Nigeria’s first military Head of State, late Aguiyi-Ironsi’s alma mater in Abia

July 13, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Kenya’s record-breaking athlete Rono dead

February 15, 2024
3

Rejecting motion to immortalise late Humphrey Nwosu very undemocratic – Senator Victor Umeh

March 27, 2025
4

Why we covered Tinubu’s Chicago certificate scandals – Former Governor El-Rufai confesses

March 16, 2025
5

I don’t believe it’s appropriate Iran should be at World Cup for safety — Trump

March 13, 2026
6

We’ll not allow anyone hold down PDP – Governor Makinde

February 3, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Police probe arrest of PDP chairman, INEC officials in Ogun

August 16, 2025

Unbearable cost: Table, sachet water producers close shop

February 12, 2024

Tinubu’s request sparks heated session at House of Reps

June 27, 2024

Suspect arrested in Mexico over 1994 presidential candidate’s murder

November 11, 2025
Top posts

Categories

  • News5156
  • Politics4867
  • Crime4626
  • International3229
  • Sports2596
  • Business & Economy2378
  • Headlines2289
  • Education1450
  • Matilda Showbiz1054
  • Health945
  • Entertainment887
  • Africa616
  • Religion500
  • Environment403
  • Special279
  • Info Tech265
  • Arts & Culture244
  • Inside Akwa Ibom Today234
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview198
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade137
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact