Skip to content
Sunday 26 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Sallah meat! Sallah meat!! I don tire

The FrontierThe FrontierJune 22, 2024 3271 Minutes read0

As una no wan ask me how me and Sikiratu waka for Ileya wey jus finish dis week, me sef don put my mouth for permanent position of shut up.

Di only ting I fit talk be say, troughout dat holiday, me and my guonguoro no go any wia for even one minute. I been dey busy dey do sometin somewia with somebody. If you know, you know.

Di only ting now be say, since I resume work after di Ileya, plenty people don come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Jumoke wey dey bring sachet ogogoro and Igbo come sell for our union member dem, Aisha wey dey bring hot Agbo and di order sisi with extra-large Ikebe wey dey carry Ewa Agonyi for head come sell (Mobile buka), all of dem don come our garage after di odun.

I no be dia customer o, but all of dem come meet me one by one since dis week after Ileya. Di only ting dem dey ask na, “Oga MAT wia my Sallah meat?”

And na di same ting all di passenger dem wey I don carry dey ask me since I resume work dis week after me and Sikiratu (ah, my mouth shut up!).

Everybody dey ask me for Sallah meat like say I follow kill ram. Wetin concern agbero with overload? For wia I for see N1.2m take buy ram for Ileya wen I no be SINator or member of House of RepresentaTHIEVES? I no even be one of dose people wey dey follow Baba for nyash, sote wen Baba fall down flat for ground finish, dem go talk say Baba dobale or Baba do swagger.

Na im make di ting tire me wen everybody dey ask me for Sallah meat wen dem know di people wey kill one million ram as Constituency Project. Tori Olorun!

Abeg make una helep me warn dem say make dem no ask me for Sallah meat again o.

Make we jam again next week Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
donOga MATSallah meattire
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife threatens to kill me for failing to satisfy her in bed
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Why I never wanted to be linked to my late grandpa Obafemi Awolowo when I went for BBNaija  —  Seyi

July 25, 20260
Gists

Pal Akalonu: Man who shaped Nigeria music; produced Christy Essien, Oriental Brothers, others

July 25, 20260
Gists

I left public eye to build my brands — Nollywood actress Tayo Sobola

July 25, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Health

Lassa fever death toll hits 229 as fresh infections rise

July 26, 20260
Sports

Arsenal eye Vinicius Jr as Real Madrid push for Diomande — Reports

July 26, 20260
Politics

Voter registration: INEC ends exercise today as opposition demands extension

July 26, 20260
Sports

BREAKING: Anthony Joshua wins first match after December deadly accident in Nigeria

July 26, 20260
International

Nigeria’s envoy to India assumes duty, targets stronger trade, investment ties

July 26, 20260
News

New NURTW chairman in Osun counters Governor Adeleke’s directive, resumes motor park activities

July 26, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Lassa fever death toll hits 229 as fresh infections rise

July 26, 2026

Arsenal eye Vinicius Jr as Real Madrid push for Diomande — Reports

July 26, 2026

Voter registration: INEC ends exercise today as opposition demands extension

July 26, 2026

BREAKING: Anthony Joshua wins first match after December deadly accident in Nigeria

July 26, 2026

Nigeria’s envoy to India assumes duty, targets stronger trade, investment ties

July 26, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Lassa fever death toll hits 229 as fresh infections rise

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Bad Bunny to star in movie about Puerto Rico

February 20, 2026
3

Tinubu names new Federal Polytechnic in Abuja after self

January 21, 2025
4

Arsenal stumble at home, hand City lifeline in title race

April 12, 2026
5

Mahrez penalty takes Algeria to AFCON last 16

December 29, 2025
6

FG unveils plans for aircraft manufacturing in Nigeria

January 22, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

2027 elections: INEC receives 7 additional applications, set to open party registration portal

July 10, 2025
3

Truck crushes 3 policemen, suspect to death

December 21, 2024
4

Oil workers shut petroleum varsity, accuse Vice Chancellor of high-handedness

July 24, 2025
5

Obasanjo hosts Jonathan, Atiku, Ooni, others

March 3, 2025
6

June 12: FG declares public holiday to mark Democracy Day

June 8, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

BBNaija S10: Rooboy, Otega, Kuture secure immunity as 22 housemates face possible eviction

August 12, 2025

Post #18900

May 21, 2025

BREAKING: Kirikiri Prison officials suspended over Bobrisky bribery scandal

September 26, 2024

Alleged cyberstalking: Court rejects activist Sowore’s documents in trial on false claim against Tinubu

February 5, 2026
Top posts

Categories

  • News4810
  • Politics4429
  • Crime4279
  • International2959
  • Sports2381
  • Business & Economy2230
  • Headlines2179
  • Education1336
  • Matilda Showbiz967
  • Health851
  • Entertainment779
  • Africa555
  • Religion475
  • Environment356
  • Special271
  • Info Tech236
  • Arts & Culture234
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today196
  • Interview183
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade126
  • World Cup 202694
  • Advert32
  • Trends20
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact