Skip to content
Wednesday 21 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Shey, dem don change our national anthem?

The FrontierThe FrontierFebruary 10, 2024 5962 Minutes read0

I still remember wen we dey for night school for our village for Ogbomoso, as we jus enter class like dis, di teacher go say make we sing national anthem. Na so everybody go sing, “Nigeria we hail thee, our own dear native land…”

Na so we dey do till I enter Standard 5 before I run comot for village come learn mecho work for Lagos in 1965.

Abeg make una no ask me wetin make I run comot for village, I know dey like to remember dat ting wey Arike Papa do me. Di wicked man say na me give im pikin, Arike, belle jus becos me and Arike dey siddon di same table for class. Na only our body dey touch o. Shey, touching body fit give person belle? Arike Papa wan take African Insurance finish me, na im I japa. Olorun Oba o!

SDP Poster Layout

Anyway sha, dat na tori for anoder day, dat is, if una don forgot di full tori…

As I talk am teletele, na wen we sing “Nigeria we hail thee” finish, na im our teacher go begin teach us for class.

As I come Lagos, small time I hear say dem don change di national anthem to one disco song like dat wey dem go begin nack drum before dem go begin sing, Arise kini kan, kini kan. Na dat Arise dem don dey sing till now.

E never reach one year wey Baba enter Aso Rock, di national anthem don dey change small small again.

Since dis year start, di only ting wey you go hear for everybody mouth na, “Ebi npa wa o!”

I first hear am for my passenger mouth wen dis year jus show first. Di passenger say make I carry am for drop go Alapere. As e jus enter my guonguoro, e siddon for back seat. Na im we begin dey go, small time I hear am shout, “Ebi npa wa o!” I look back to see who my passenger dey talk with, wen be say na only im enter my guonguoro for our garage wey dey near Ikeja under bridge. I see say na phone call e make.

Since dat time, na so, so “Ebi npa wa o!” I dey hear for people mouth for Lagos.

Last week wey I carry passenger for drop go Idumota, na im woss pass. All dose Area Boy dem for Isale Eko, if any small Go Slow dey, na so dem go waka come nearly put dia face inside any motor wey dem see, dem go talk say, “Abeg give us sometin make we take buy food, ebi npa wa”. Tori Olorun! If you wind down your glass window, na you sabi.

Dis morning, I come dey talk am for my mind say, e be like say dis new song, “Ebi npa wa o!” don use style take over from “Arise…” small small, since Baba enter Aso Rock. Na im make I ask weda or wedant Baba wan turn “Ebi npa wa o!” to di new national anthem.

If na so, make Baba kukuma put am for oyibo make everybody fit sing am say: “Hungry don kill us o!”

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.

 

Tags
anthemchangedemdonNationalOga MATShey
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: JEUN TO DA (JTD), By Reekado Banks
next post ROMANCE GONE SOUR: My husband kept it a secret that he has another wife, can’t father a child
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Two movie roles that pushed me out of my comfort zone — Actress Etinosa

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Neto double gives Chelsea win over Everton; marred by Martinez injury

October 17, 20260
Gists

Walk away if marriage isn’t working — Nollywood actress Uche Ogbodo

October 17, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Info Tech

House of Reps gives MTN, Airtel, Glo, others seven-day ultimatum over poor network

October 21, 20260
Health

Ebola scare rocks National Assembly as senators refuse to shake hands

October 21, 20260
Health

EBOLA: Anambra monitors seven persons of interest

October 21, 20260
International

Why I want to reconcile with my royal family – Prince Harry

October 21, 20260
Politics

Activist Sowore’s party AAC seeks approval to inaugurate campaign council in Presidential Villa Abuja

October 21, 20260
International

Toppling Iran government only way to end threat, says Israeli Prime Minister Netanyahu

October 21, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

House of Reps gives MTN, Airtel, Glo, others seven-day ultimatum over poor network

October 21, 2026

Ebola scare rocks National Assembly as senators refuse to shake hands

October 21, 2026

EBOLA: Anambra monitors seven persons of interest

October 21, 2026

Why I want to reconcile with my royal family – Prince Harry

October 21, 2026

Activist Sowore’s party AAC seeks approval to inaugurate campaign council in Presidential Villa Abuja

October 21, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

House of Reps gives MTN, Airtel, Glo, others seven-day ultimatum over poor network

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Easter tragedy in Gombe: Pain persists, calls for justice rise one month after

May 30, 2025
3

Wahala everywia, me sef wan go vacation

October 5, 2024
4

JUST IN: Fake drugs worth N300 million seized in Lagos •PHOTOS

November 28, 2024
5

Supreme Court: NNPP organises prayer, warns Tinubu against interfering in Kano guber case

December 12, 2023
6

BREAKING: Akwa Ibom Police boss presents N88.6 million to families of deceased officers

October 21, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Many feared dead as task force vehicle crashes into tipper in Anambra

January 31, 2025
3

CBN blacklists top loan defaulters

March 27, 2026
4

Nigerian girls breaking grounds despite challenges – Commissioner

October 21, 2024
5

No vacancy in Senate presidency — Senators declare

October 15, 2026
6

Anambra tricycle operators, passenger accuse police of extortion

July 16, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Military to try officers over alleged coup plot to overthrow Tinubu

January 26, 2026

Hunger is killing us – Protesters resurface in Katsina, wave Russian flag

August 6, 2024

Those against PDP convention are pushing for one-party state — Party chieftain

November 12, 2025

Sachet alcohol ban rushed, harmful to economy — Group

January 23, 2026
Top posts

Categories

  • News5171
  • Politics4885
  • Crime4641
  • International3244
  • Sports2602
  • Business & Economy2382
  • Headlines2295
  • Education1453
  • Matilda Showbiz1054
  • Health958
  • Entertainment889
  • Africa619
  • Religion501
  • Environment405
  • Special279
  • Info Tech268
  • Arts & Culture244
  • Inside Akwa Ibom Today235
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview198
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade138
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact