…Continued from last Saturday episode As my wife Bose, jump comot for bed, go lie down for ground for dat kind cold night, I no come sabi wetin I go do again. And sleep no wan catch me. How sleep go catch me wen my kini still tanda for attention paparapa? Na so I come […]
Di kind cold wey dey since dis week show face, hmm, if all dis sisi and bobo dem no take time, Naija go reach 2 billion people after nine months. No be sisi and bobo dem alone, even husband and wife dem dey inside. Now, to stand up for bed for morning, put my guonguoro […]
Di kind tings wey dey shele for dis Lagos now, I confuse. Man pikin go comot for house for early morning before everybody wake up, I go put my guonguoro for road, to go find wetin I go take give my family food, na so rat go come wake cat wey dey sleep up. Di […]
…Continued from last Saturday edition As I look time see say 10 O’clock pm in di night don nack, I rush di last bottle of My Usual and Point-and-Kill, den tell Madam Shine make e give me my bill. Madam Shine tell di salesgirl make e give me my bill. I say no, dat na […]
Noting wey di son of man no dey see for dis our taxi driver work. Na im make my wife Bose dey talk am say taxi driver work na Ashewo work. And wen e talk like dat, I go tell am, “Go to court”. Me sef go tell am say “On your mandate”. Na so […]
…continued from last Saturday edition As I match break and pack my guonguoro for roadside, I tell di sisi make e come down, I no even remember to tie my shokoto rope back, I open my driver door and come down. I turn go passenger door, I open am, say make di oloshio come down […]
Di kind wahala wey man pikin dey see for dis our taxi driver work everyday, I don dey tink dis new year weda or wedan’t make I stop di work. But di ting be say, if I say make I no do taxi driver work again, na wetin I go come dey do as I […]
Una kukuma remember say, as Keresimesi near last year, na so all dose Lagos sisi dem dey come dey rush me make I do Keresimesi for dem. I talk am for my mind say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimesi? My broda, na so I took off o, I no show face again […]
Dear Oga Patapata, I dey vex for you well well, but before I start dis my letter to you, make I still manage to say Happy Keresimesi and Mary (or Remi) New Year wey dey come, to you. Oga Patapata, why I dey vex for you no be becos you allow Oyibo bring jet come […]
Dem dey talk am say body no be wood. And na true talk. You sef check am nah. Everyday di son of man dey for Lagos road 24/7, dey carry passenger dem upadan. And na orisirisi tings I dey see for road – di good, di bad, and di OBJ (sorry, abeg no vex. I […]

