Una kukuma remember say, as Keresimesi near last year, na so all dose Lagos sisi dem dey come dey rush me make I do Keresimesi for dem. I talk am for my mind say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimesi? My broda, na so I took off o, I no show face again […]
Dear Oga Patapata, I dey vex for you well well, but before I start dis my letter to you, make I still manage to say Happy Keresimesi and Mary (or Remi) New Year wey dey come, to you. Oga Patapata, why I dey vex for you no be becos you allow Oyibo bring jet come […]
Dem dey talk am say body no be wood. And na true talk. You sef check am nah. Everyday di son of man dey for Lagos road 24/7, dey carry passenger dem upadan. And na orisirisi tings I dey see for road – di good, di bad, and di OBJ (sorry, abeg no vex. I […]
Every year by dis time, na so so Lagos sisi dem man pikin go dey see left, right and center. And all of dem wan make you do Keresimasi for dem. Even all dose sisi dem wey no dey greet me for our street for Abule Egba, now if dem see me, dem go first […]
(Continued from last week) As I open di door and follow di two Soja, dem carry me go di two truck wey dem bring come. Dem bring 10 jerry can down. Dem say na petrol and na me get am. Na so dem drive comot, begin dey go. I jus tanda for outside dia, everytin […]
Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat, especially as Keresimesi don dey near so. First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”. Wen you settle dat one, […]
Since two week now, na so, so Trump dey for all Naija people mouth. You go to market, na Trump. Go to church or mosque, na Trump. Go to any school, na Trump. Waka for road or enter taxi, BRT, danfo, Keke Marwa or Okada, na Trump. Di ting come get as e be since […]
…Continued from last week Na im di pelenge man wey our union chairman Jimoh bring come our garage for meeting, talk say report get to am for state chapter say all of us dey plan to overthrow our branch chairman Jimoh. Say na me, Oga MAT, be di chief coup plotter wey dey plan to […]
…Continued from last week’s episode As I jus drive enter our garage, I see say everybody complete. I look time, e remain 20 minute make 4 nack. Small time, I see one pelenge man enter garage, go meet our union chairman Jimoh. Jimoh say make all of us come, say our union exco member for […]
Our garage wey dey near Ikeja under bridge hot yesterday gan. Dat yesterday morning, our chairman, Jimoh, call all our union member dem for phone, one by one. Jimoh tell us say any wia we carry passenger go dat yesterday, make we make sure say we come back to garage latest 4 o’clock pm in […]

