I still remember wen we dey for night school for our village for Ogbomoso, as we jus enter class like dis, di teacher go say make we sing national anthem. Na so everybody go sing, “Nigeria we hail thee, our own dear native land…” Na so we dey do till I enter Standard 5 before […]
Continued from last Saturday… I rush di last bottle of My Usual and Point-and-Kill, den tell Madam Shine make e give me my bill. Madam Shine tell di salesgirl make e give me my bill, I say no, na you Madam Shine, go give me bill, and make e do quick, say time don too […]
Noting wey di son of man no dey see for dis our taxi driver work. Na im make my wife Bose dey talk am say taxi driver work na Ashewo work. And wen e talk like dat, I go tell am, “Go to court”. Na so di two both of us go come laugh. But […]
…continued from last Saturday edition I tell di sisi make e come down, I no even remember to tie my shokoto rope back, I open my driver door and come down. I turn go passenger door, I open am, say make e come down kia kia. As I dey tell di sisi to come down, […]
Di kind wahala wey man pikin dey see for dis our taxi driver work everyday, I don dey tink dis new year weda or wedant make I stop di work. But di ting be say, if I say make I no do taxi driver work again, na wetin I go come dey do as I […]
Una kukuma remember say, as Keresimasi near last year, na so all dose Lagos sisi dem dey come dey rush me make I do Keresimasi for dem. Even all di sisi wey no dey greet me for our street for Abule Egba, if dem see me dat time, dem go first smile, den dobale, and […]
Dear Oga Patapata, I dey vex for you well well, but before I start dis my letter to you, make I still manage to say Happy Keresimasi and Mary (or Remi) New Year to you. Oga Patapata, why I dey vex for you na wetin you tell your boy make e announce to all Naija […]
If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija. Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse everyday, money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass na petrol. To buy petrol now na like gold. And without petrol, […]
Every year by dis time, na so so Lagos sisi dem man pikin go dey see left, right and center. And all of dem wan make you do Keresimasi for dem. Even all dose sisi dem wey no dey greet me for our street for Abule Egba, now if dem see me, dem go first […]
(Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver, with Grandmaster Sunny Okim) I no know wetin dis our union chairman, Jimoh, tink say im be sef. Imagine di likeness! Since wen me and all our union member dem begin use dat our garage wey dey for Ikeja under bridge, long time ago, every time we wan […]

