…continued from last Saturday edition As di sisi bring out my kini, bend down to put am for im mouth, na im I match break fiaaaam! I tell di sisi make e come down, I no even remember to tie my shokoto rope back, I open my driver door and come down. I turn go […]
Di kind wahala wey man pikin dey see for dis our taxi driver work everyday, I don dey tink dis new year weda or wedant make I stop di work. But di ting be say, if I say make I no do taxi driver work again, na wetin I go come dey do as I […]
I talk am last week say I go nack una di tori as me and Sikiratu waka for Keresimesi. I tell una say na for inside one short time like dat wey my Siki Babe book for Oshodi di two both of us go do our Keresimesi. I tell una say na secret o, na […]
Dem dey talk am say body no be wood. And na true talk. You sef check am nah. Everyday di son of man dey for Lagos road 24/7, dey carry passenger dem upadan. And na orisirisi tings I dey see for road – di good, di bad, and di OBJ (sorry, abeg no vex. I […]
Every year by dis time, na so so Lagos sisi dem man pikin go dey see left, right and center. And all of dem wan make you do Keresimasi for dem. Even all dose sisi dem wey no dey greet me for our street for Abule Egba, now if dem see me, dem go first […]
Replay Di kind orisirisi tings wey man pikin dey see for dis our taxi driver work, person no fit talk am finish. Di order day, trailer nearly push me, my guonguoro and my passenger inside Lagos Lagoon. Helep me say Olorun maje! Na so I carry one madam like dat for drop go Balogun market. […]
Since wen I run comot for my village for Ogbomoso come Lagos in 1965 becos of dat wicked Arike Papa, na today I here say pastor dem dey retire for work. Na wa o! Dis morning, as I jus land for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na im one oga like dat, […]
…continued from last Saturday’s edition I turn go left for bed, turn go right, turn go forward and turn go back, dem still dey shout for loudspeaker. Na im I jump up, go wia di noise dey come from. I see say our landlord, Baba Briamoh, don start mosque for di compound. And e come […]
Anyting wey person see for dis world make e take am say na so Eledumare wan make e happen. Yes nah. Person fit dey down today, tomorrow sometin go happen wey go make di person position change, di person go upgrade. Na after later di person go come know say, if dat ting, wey im […]
(Response from readers) My people, since I begin nack una di tori above, di son of man no rest again. Na so readers dey bombard me left, right and center, sote, di battery of dis my torchlight chinko phone don nearly peme becos of plenty message. And e come be di time wey our national […]

