Anyting wey person see for dis world make e take am say na so Eledumare wan make e happen. Yes nah. Person fit dey down today, tomorrow sometin go happen wey go make di person position change, di person go upgrade. Na after later di person go come know say, if dat ting, wey im […]
(Response from readers) My people, since I begin nack una di tori above, di son of man no rest again. Na so readers dey bombard me left, right and center, sote, di battery of dis my torchlight chinko phone don nearly peme becos of plenty message. And e come be di time wey our national […]
…Continued from last edition As Bose push me dat night comot for bed make I nack my head for ground pppossaahh!!!, e no stop dia o. Bose come begin dey shout dat night. Notin wey my wife no tell me. Bose curse me like say I tief im ting. E say I don dagba finish, […]
Dis rain wey don come now for Lagos, shey no be wahala e bring come so? Rain don dey fall teletele everywia for Naija since dis year show face, na only Lagos been remain. Na now wey be say dry season suppose show face, na im rain don begin fall for Lagos. And e come […]
I no trust anybody for dis my taxi driver work. Noting wey my mouth never see in di curse (Olorun maje!) of my work for Lagos road everyday. Dem plenty: Amu robber o, Gbomo gbomo dem wey don upgrade now to kidnapper o, Oloso o, Ritualist o, Yahoo Boys o! But di one wey bad […]
(Continued from last edition) Di two Soja dem wey come knock my door carry me go di two truck wey dem bring come. Dem bring 10 jerry can down. Dem say na petrol and na me get am. Na so dem drive comot, begin dey go. I jus tanda for outside dia, everytin come be […]
Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat. First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”. Wen you settle dat one, di next ting na, “Sweetie, my mama […]
As tings come be now, na im be say all of us wey dey for Naija no know wia we dey go again. Na so I carry one bobo like dat dis week go drop for Gbagada Estate. As we comot for our garage wey dey near Ikeja under bridge, we no even reach Alausa […]
Replay I no come know how di son of man go take dey do dis our taxi driver work again for Lagos. If no be petrol wahala, na protest. Di one wey dey give me headache now na di kind Go-Slow wey dey for Ikorodu Road. Una kukuma know say Ikorodu Road na im be […]
I no trust anybody for dis my taxi driver work. Noting wey my mouth never see in di curse (Olorun maje!) of my work for Lagos road everyday. Dem plenty: Amu robber o, Gbomo gbomo dem wey don upgrade now to kidnapper o, Oloso o, Ritualist o, Yahoo Boys o! But di one wey bad […]

